Kudirat Abiola Children Sue Federal Government, Dey Ask For $10 Million

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Children of late Kudirat Abiola, di wife of di winner of di 1993 presidential election, MKO Abiola, don sue Nigerian government say dem kill dia mama.

Di suit ECW/CCJ/APP/62/2022 dem file am before di ECOWAS Court of Justice, Abuja on Tuesday by dia lawyer, Femi Falana (SAN).

Khafila Abiola, Hadi Abiola, and Moriam Abiola, wey bring di suit on behalf of Kudirat children, say as dem take kill  “Kudirat Abiola e no follow wetin our law tok.

Dem also argue say“ di defendant throway face to protect di life of Late Alhaja Kudirat Abiola in the Republic of Nigeria no follow wetin law tok for Articles 1,4,5,18 and 23 of di African Charter of Human and Peoples’ Rights.”

Dem want make court pass order wey go alklow dem fit charge Sergeant Barnabas Jebila (a.k.a. Rogers), Mohammed Abdul (a.k.a Katako), and Aminu Mohammed for di killing of Mrs.Kudirat Abiola in Lagos on June 4, 1996.”

Dem also want make court pass order “wey go make di defendant pay $10 million to compensate for di killing of Alhaja Kudirat Abiola.”

Dem shoot Mrs. Abiola for her car for Lagos on 4 June 1996 when she dey lead di campaign her husband wey dey detention bcos eim declare himself president ontop di result of di 1993 election wey dem cancel.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C