On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Kill That Chicken On Friday Or Else - Kano Court Tell Man

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One court for inside Kano state don draw hand for ear tell one Malam Yusuf say that Cockrel wey eim buy must die by Friday.

The reason wey make Magistrate Halima Wali tell am this one na because Yusuf neighbour carry am come the court to report am say the chicken dey use noise disturb am the house.

Eim still tok say the chicken don become alarm clock wey no get control again, because of the chicken dem no dey fit sleep again for dia house.

Yusuf wey get the chicken say na because of good Friday na eim make go buy the chicken ooo, so that him and eim family go fit jollificate for the Easter season. 

So after Magistrate Wali chook eye ontop the mata, she come draw hand for ear tell Malam Yusuf say make eim no allow the chicken dey waka anyhow again and make that chicken no dey alive after Friday. 

She say if after Friday the chicken still dey alive, Malam Yusuf go face serious penalty from the court.

But no be crime for person to dey train goat, sheep or even chicken abi any other type of bird wey the person wan chop or sell for sharp-sharp money for where dem live.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 22°C