Kaduna Students: Kidnappers Dey Ask For N1bn Ransom, Or Dem Go Kill School Pikin Dem In 20 Days

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di kidnappers wey kidnap di Kaduna school children don talk to di tok tok pesin of di families wey dem kidnap and dem dey demand for 1billion naira before dem go release di student dem.

According to Reuters, di kidnappers don promise say dem go kill di students and di staff when dem kidnap in 20 days if dem nor give dem wetin dem ask for.

On march 7th 2024  bandits attack di Kuriga community wey dey for Chikun local government area for kaduna state and kidnap about 286 students join some teachers for the LEA Primary school kuriga.

Idris Ibrahim wey be official from di Kuriga Ward municipal Council, confam di amount wey di kidnapers ask for.

Na true say di kidnappers call di community through Jubril Aminus phone make di demand. Na so idris Ibrahim tok.
Dey call from one hidden number but di police people dey work to get the number. Ibrahim tell Reuters

He also tok say di security people dey take extra effort to secure di release of di students wey dem kidnap

Presido Bola Ahmed Tinubu, on March 12, 2024 direct some security agencies and di ministry of defence, say make government no pay any money to di kidnappers,for di release of di people when dem kidnap


According to jubril Aminu, di community leader wey dey act as di tok tok pesin of  di families wey dem kidnap say dem make a total of 1billion naira ranson when di kidnapper demand for all di students and the staff of the school

 

How u see di mata? #chookmouth


 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 24°C