On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Ivan Omorhiakogbe Killing: Reps Don Ask IGP to Take Over Di Case

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di House of Representatives don call for di punishment of di bad guys wey kill one two-year-old in Delta State.

Di house don ask di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun to carry di case.

Ivan Omorhiakogbe kpai afta stray bullets bin meet di 2 year old wey di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) pipo bin fire Thursday last week. Di bullets bin wound him sibling too.

Honorable Unyime Idem wey be di lawyer wey dey represent Ukanafun/Oruk Anam Federal Constituency tok say di tins wey lead to di death of Ivan e no sweet at all.

Ivan papa bin present petition to di House by Honourable Kelchi Nwogu wey e dey beg for justice.

Sheriff Oborevwori wey be di Governor of Delta State don tell NDLEA and di police say make dem investigate di mata and arrest di pepo wey do am.


NDLEA don com out say dem go get to di bottom of dis mata.

Dem still kon talk say dem dey in touch wit eim family wey go help dem wit informat wey dem go need to investigate dis mata.

"We will like to assure di family and members of the public that we'll get to the root of the case and take necessary action(s)"

How una see dis mata??
#Chookmouth
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Thundery shower

    High: 31°C | Low: 22°C