On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

How Woman Wey Dey Get Hard Labor Born Her Pikin In Peace After She Call Gov Wike Name

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Edison Ehie tok say one woman wey bin dey find am difficult to born her pikin don born safely after she call Gov Wike name three times.

Edison Ehie di deputy speaker of River State of  Assembly, on Wednesday wey be 11th of January 2023, explain how one woman wey dey find am hard to born her pikin born after she call  Nyesom Wike wey be di Governor of di state name three times.

When Ehie bin dey tok for di flag of di construction Obodhi-Ozochi road, tok say as di woman bin dey get hard labor but as she call ''God of Wike'', na im she born baby boy.

He tok say as of ''Tuesday night, di woman dey labor. She try all her best but di pikin no gree com out.

Di nurses, don dey already arrange theatre to operate di woman.

''But becos di nurses know say Governor Wike dey come Ahodia, dey dey tok among demselves say our executive governor dey com Ahodia today. Say dis man like Ahodia pipo''.

As di woman hear your name na im she shout, 'di God of Nyesom Wike, allow me born my pikin safely'.

''Three times na him di woman call your name, and to di surprise of everibody she born a bouncing baby boy without any wahala.

Your excellency, your name work wonders. Dey com meet me on Wednesday morning, com tok say dem plan to give di pikin your name.

''But, I tell dem, make dem never name deir pikin until I confam from his excellency first,'' Ehie tok.

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C