Governors, Oil Marketers Support Di Fuel Subsidy Removal

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Nigerian Governors’ Forum don tanda with President Bola Tinubu's decision to end fuel subsidy payment.

Di governors tok one by one wen Presido host dem for di state house for Abuja on Wednesday.

Dem tok say dem happy with di remove of fuel subsidy an ddi oda polices wey dis administration don start. Preisdo Tinububin don ask di governors to join federal government to comot poverty from naija. He still tok say him want make dem drop dia diffrences and focus on how dem go take comot suffer and poverty from di pipo.

Di chairman of di Governors Forum, Governor AbdulRasaq of kwara State promise say di governors go join federal government to make sure say dem meet dia targets.

Still on top dis one, di big oil marketers and distributors  don still stand with Presido on top of di fuel subsidy removal mata.

Di marketers bin tok dis one for one visit wey dem go on Wednesday.

Di chairman of Depots and Petroleum Product Marketers Association of Nigeria, Winifred Akpani tok say Nigerians go begin see di benefit fom dis one by July.

She promise say marketers go donate between 50 to 100 buses to make am easy for di masses.

Na di governor of Ogun state, Dapo Abiodun na carry di oil marketers go di meeting. Na eim be di chairman of di Depot and Petroleum Marketers Association of Nigeria before e enta politics.

 

How una see di mata?

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C