On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Gov Ganduje Don Ready To Sign Death Warrant For Person Wey Kill Hanifa

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Kano state Government don announce say Governor Abdullahi Ganduje don ready to sign death sentence wey dem sama Abdulmalik Tanko for oga patapata court.

Kano state commissioner of justice, Lawan Musa yarn say the governor don ready to sign for the death sentence.

Eim yarn dis one wen eim enta Wazobia FM kano ontop "We Tori Dommot" for Monday.

According to oga Musa, dem say the governor dey ready to sign the death sentence of all the pipu wey get death sentence for the state, as far as dia case no get still dey inside court. 

Dem don give the pipu wey get death sentence 3months to carry dia mata go Appeal court, so that the court go fit chook eye ontop dia sentence.


Oga Musa yarn say dem still dey wait for Appeal court, so that dem go do dia own part sharp sharp. 

Eim still say kano state no get wetin dem dey use to fit take paye pesin, So after dem don give the 3months appeal time, dem go carry the persin go Kaduna to fit paye the pesin as court talk.

Wen dem ask oga Musa if pipu no go vex as dem sharperly wen do wetin court talk for the mata, wen oda pipu don dey wait since. 

Oga musa say the other pipu ontop death row don carry dia mata go appeal court naim make dia own neva happen.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C