On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Gbas Gbos For PDP & APC

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

All-Progessives Congress Presidential Campaign Council dey tok say di presidential candidate of Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, no get di character to become di country president.

Director, Media and Publicity of APC Presidential Campaign Council, Mr Bayo Onanuga, tok dis one for tok tok wey him tok on Sunday, for Abuja.

Dis tok na as a result of wetin PDP tok say make National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) and EFCC chook eye for di APC presidential candidate, Bola Tinubu, on top drug trafficking.

PDP still tok say, Tinubu, wey be Lagos State governor two times before, dey do dirty drug business as of 2015.

But APC tok say Atiku hand no clean to continue for dis presidential waka, after one audio about him confession leak.

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C