On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Fuel scarcity Don worst for Dutse as dem don dey sell litre for N340.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di price for petroleum motor spirit (PMS) don rise to N340 per litre for Dutse, Jigawa state Capital.

Di situation don cause havoc and hardships to  pipo wey dey live dia, especially Okada pipo due to de fuel wey no dey. 

A correspondent for di News Agency for Nigeria(NAN), wey monitor petrol filling station for Sunday, come know say long line of vehicle make things no go normal for di stations.

Di filling stations dey sell di product for high amount of N340 per litre as di Dutse NNPC mega station dey lock since January 8 becus of fire wey burn dia. 

Many filling station wey dey di city no open for di long time.

for Awajil Global Resource, IMG Petroleum, Maruta Petroleum and Investment, all for Ibrahim Aliyu bye-pass, moto pipo, keke pipo, dey for long line dey wait make dem put fuel for dia tanks.

Also, Audu Manager filling station and AA Kankani Nig .Ltd, for Olusegun Obasanjo Road get long line of vehecle and dem dey also sell de product for de same price.

Filling stations like A.S.A Oil Nig.,B.A Bello Nig. Ltd and Matrix, all dem for Ibrahim Aliyu's bye-pass, no get or dey sell de product.

plenty moto pipo wey talk with di (NAN) talk say dem no dey satisfy for di product wey no dey.

Moto man wey eim name be, Ahmed Rufa'i, say di ugly situation dey make him dey loss.

" I dey plant wheat maize and every wik i nid at least 20 litres to water my farms and i nid to water dis two farms at least 20 times.

" So how much money you wan make i spend for fuel alone, we never talk transport and oda logistics.

" So plenty of us wey dey do dis farming no no weda we go make am or we go lose," Rufa'i talk m.

De management of di filling stations no gree chook mouth for di sad situation, becus " dem never allow us to talk to di press".

#chook Mouth#


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C