On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Foreign Affairs Minister Yusuf Maitama Tuggar Wan Step Down, Dey Eye Bauchi Governor Seat Race.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Nigeria Foreign Affairs Minister, Ambassador Yusuf Tuggar, don set to resign from im position as e dey prepare to contest for Bauchi State governor seat ahead of 2027 election.

Sources wey sabi wetin dey happen talk say Tuggar go step down as President Bola Tinubu don give order say all political appointees wey wan contest election must resign on or before 31st March 2026.

Dem pass dis order through Office of Secretary to di Government of di Federation, and e follow wetin Electoral Act talk plus timetable wey Independent National Electoral Commission (INEC) release for party primaries.

As Tuggar wan comot, people dey see am as one of di first big move wey serving minister dey make before election season fully start.

According to reports, dem expect am say make e resign sharp sharp come declare interest for Bauchi State governorship race.

Eim decision come as political movement don dey hot after di recent All Progressives Congress (APC) national convention, as attention don shift go meet cabinet members wey get political ambition.

Supporters from Bauchi State don already begin gather support for am, and one source talk say “eim official declaration to run for governor go happen very soon.”

Tuggar na experienced diplomat and politician. Before, e don serve as House of Representatives member, and later Nigeria ambassador to Germany before dem appoint am as Foreign Affairs Minister for 2023.

Political analysts talk say if e enter di race, e fit change how the contest go be for Bauchi, especially as people dey talk more about competence and experience for leadership.

As deadline to resign dey come close, attention don turn to other political appointees wey go soon follow di same path as preparation for 2027 general elections dey gather momentum.


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 21°C