On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

For Di Seven Years Wey I Be President, I Don Do My Best - President Buhari

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

President Muhammadu Buhari tok say wit di plenty wahala wey Nigeria dey face for many areas, him ''don do him best for di seven-and-half years''.

Him tok dis one for Washington when him dey welcome di Secretary-General of di Abu Dhabi Forum, Sheikh Al-Mahfoudh Bin Bayyah.


 For talk by di Senior Special Assistant to di President on Media and Publicity, Garba Shehu, Buhari promise to continue to dey find solutions to di problems wey dey disturb di youths for di country.

    Di statement tok say : 


STATE HOUSE PRESS RELEASE


PRESIDENT BUHARI GO COLLECT AWARD FOR PEACE AND SECURITY, SAY DI YOUTH TOO MUST FOCUS 

 President Muhammadu Buhari, on Tuesday for Washington talk say di country  youths na di promise for a better future, and solving deir problems na di priority of di government.


 Him tok dis one as him dey welcome di Secretary General of di Abu Dhabi Forum, Sheikh Al-Mahfoudh Bin Bayyah, and him deputy, Pastor Bob Roberts of di US who come visit am, President Buhari tok say di work of di foundation to dey promote multi-faith (plenty religion) dialogue dey important to di world as e dey to Nigeria.


 He tok about di need to raise generations of youths wey no get religious extremism and intolerance, gingering di group to continue to dey target di young people who be di promise of di future.


  ''Una work dey very important to dey help di youth, to dey understand one another and at di same time, to dey proud of deir heritage. Dis better idea wey una bring go help future generations to plan well and live together for peace. For our part, we go continue to solve our problems, especially di ones wey concern di youth. We dey big for size and population, facing plenty wahala, for different areas, we dey try. For seven-and-di half years, I don do my best'', na so the President talk.


Di Foundation Secretary General say dey come to tell di President, and to invite am make him come collect di award wey dem arrange for am, Di Abu Dhabi Foundation's award wey show him outstanding achievements for promoting peace and security.


Dey tok say di collection of di award wey dem arrange to give am na for di Foundation's work wey be fighting religious extremism and to dey promote peaceful living together and tok among all religions.


 Garba Shehu

 Senior Special Assistant to the President

  (Media & Publicity)

  December 13, 2022


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C