Firefighters Save Nine People From Six-Storey Building Wey Catch Fire for Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Lagos State Fire and Rescue Service don rescue nine people from di fire wey happen for six-storey building for Afriland Tower, Broad Street, Lagos Island.

Di Deputy Controller-General of di agency, Mr Ogabi Olajide, yarn dis one inside statement on Tuesday for Lagos.

E talk say dem don rescue nine people in total, out of which five don wake up back.

“Na nine people we don rescue in total, and five don regain demself.

“Plenty others escape without injury, while dem still dey try resuscitate di remaining four,” na so e talk.

According to am, di matter bin happen exactly 1:38 p.m., and dem deploy fire crew wey near di scene sharp-sharp.

“After di call enter, fire crew from Ebute Elefun Fire Station and Sari Iganmu Fire Station rush go.

“Na for inverter room wey dey basement di fire start, but smoke don spread reach many floors and don full di whole building,” na wetin e tok.


Abuja Weather

  • Abuja

    Light rain

    High: 27°C | Low: 20°C