On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Fire burn Iyabo Ojo office for Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?
Iyabo Ojo

Nollywood actress and business woman, Iyabo Ojo, don talk say fire burn her office wey dey for Lagos.

Di actress talk say di fire happen around 7pm on Tuesday night. For one video wey she post for her Instagram page, one part of di building burn well-well. 

But nobody die for di fire wahala.

She write say, “Na today, 8th of July 2025, around 7pm, my office building catch fire.”

Ojo come thank Lagos State Fire Service and her workers for how dem take quick respond and help save wetin remain.

“Thank you to Lagos State Fire Service and my staff for wetin una do to save di small wey remain. Thank God say nobody die. Devil try test us today, but God talk say 'lai lai!' With God by my side, we go come back bigger and better."

Di actress wey people sabi say she strong well-well, still tell her fans say she go come back even stronger..


Abuja Weather

  • Abuja

    Light rain

    High: 26°C | Low: 20°C