FG go punish Airlines wey dey sell tickets in dollars

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?
Minister of Aviation, Hadi Sirika tok say dem don tell Nigerian Civil Aviation Authority make dem punish any airline wey dem catch wey dey sell flight ticket in obodo oyinbo moni.

Federal Government dey warn airlines say dem go punish dem if dem sell flight tickets in obodo oyinbo moni, sake of di scarcity of foreign exchange wey dey Naija.

Minister of Aviation, Hadi Sirika tok dis on Wednesday for one news conference afta di Federal Executive Council meeting for Abuja.  

He tok say dem don tell Nigerian Civil Aviation Authority make dem punish any airline wey dem catch wey dey sell flight ticket in obodo oyinbo moni.

He also tyok say federal government don release $265 million to settle airlines wey dey complain say dem neva see di ticket moni of npipo wey dem deport.

He say government dey work on plan wey go stop airline moni to dey Naija. 

He say Central Bank and our economic managers go make sure say di moni no go dey pile up again.

“We dey do everything wey go make these airlines happy for Nigeria. We need dia service but dem need our market. Dey need our market more.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C