On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Emefiele:Na Bank dem go blame for new naira wey no plenti outside.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di oga kpata kpata for central bank of Nigeria (CBN) Governor Godwin Emefiele done talk, say na bank dem go blame for new naira note wey no plenty outside, eim talk dis yesterday.

Eim talk say some bank never do wetin dem suppose do to load di new naira to di Automatic Teller Machine (ATMs).

Emefiele talk say, di bank dey busy dey give pipo wey wan spray di new naira for parti.

Many Nija pipo wey need new naira don dey waka for ATMs wey dey for di countri. 

Bank don stop do dey give old notes, wey go stop to be legal for February 10, but di new notes no dey plenty. 

Emefiele, wey make wi undersand say di old note can be deposite after de deadline, talk say, dey don send Agencies wey go punish banks and officials wey no dey do wetin dem suppose do.

Di oga for CBN talk wen eim show before di House of Representative Adhoc Committee on di New naira Redesign.

Pipo wey follow am for vdis visit na Deputy Governors Aisha Ahmed (Financial System Stability), Edward Adamu (Corporate Service), Ade Chanubi (Operations) and Kingsley Obiora( Economic Policy).

Di House and di CBN don agree dat dem no go put time limit to di validity of di old naira notes after di February 10 deadline, as em dey for law.   

Di CBN governor talk sayeim, dem don send di Economic and Financial Crime Commission (EFCC),di Independent Corrupt Practice and other related offences Commission (ICPC), di Nigerian Financial Intelligent Unite (NFIU) and di Department of State Services(DSS) to dey look for pipo wey no dey do wetin dem do. 

"I dey hapi dat even yesterday (Monday), i read dat di DSS don start to dey check, as eim be wetin we want."

Emefiele beg nija pipo wey no dey hapi becos of di stress dem dey go for dis last few days.

"Na eim make we add 10 days for more and more of dis to bi collected." 

Chairman of di Committee and House Leader, Alhassan Ado Doguwa talk say eim good mey Emefiele dey talk, say na only wen eim talk dey go dey understand di policy of di government.

"If you (Emefiele) don talk dis on time, di wahala for not come atal. nija pipo for dey without any fear atal."

"I thank you for wetin you do, di one wey pass na position of di law, di bank go respect de position of di laws wey for hand.

E dey clear and every thing don dey open. i wan thank you on behalf of di committee for bringing law matter."

Doguwa talk to di house during plenary dat di CBN governor don agree for anoda extension to dey collect old note if dey possible.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C