On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Edo Assembly Don Summon Natasha Osawaru Over Viral Video Wey Burst Out For Inside Her Marriage Wahala.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Edo State House of Assembly don summon Hon. Natasha Irobosa Osawaru, wey be Egor Constituency lawmaker and wife of singer Innocent “2Baba” Idibia, make she come answer questions about one video wey don go viral.

Speaker Blessing Agbebaku tell him colleagues for Tuesday plenary say di video and other clips “don dey trend negatively for media,” and di lawmaker must show face for di House Ethics and Privileges Committee within one week. Di committee get two weeks to report back to di Assembly.

Agbebaku talk say di member must explain her behavior and why di House no suppose take action. E tell di chamber:

“Hon. Natasha Irobosa don get summons to appear before di Ethics and Privilege Committee because of her recent conduct wey dey trend online.

“Dis kain behavior dey drag di name of di House enter mud, and e dey important make members of di Assembly carry themselves well.

“This House get intelligent and educated people, but dem don dey drag us for mud for too long because of our colleague, Hon. Natasha. She don dey trend for social media and television for wrong reasons.

“This House get members wey sabi wetin dem dey do, but di attitude of our member don bring dis House to disrepute, and we no go gree.”

Di summons follow video clips from one recent Instagram Live wey show hot argument between di singer and Natasha, plus another clip wey show police arrest di singer for United Kingdom.

Di videos don cause plenty reactions from fans and social media people.

Natasha get one week to “show reason why disciplinary action no go follow her,” na so di Assembly talk.

Na di Ethics Committee go decide next action after dem finish dia investigation.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny

    High: 35°C | Low: 20°C