On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

DSS Commot Officers Wey Dem Give Adeleke Over Wahala with Police

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Osun State government don confirm say di disagreement wey dem get with police cause make dem commot di officers of di Department of State Services wey dey protect di Governor.

For tok wey Governor Adeleke spokesperson, Olawale Rasheed, release on Sunday, him confirm say, ''small  disagreement'' bin happen between di two security agencies.

He also tok say dem don report di matter give di headquarters of di two agencies.

''Di Osun State Government don dey concern on di so-called withdrawal of di security people wey suppose to protect Governor Ademola Adeleke'', di statement tok.

''We won confirm say na small disagreement between officers of di Department of State Services (DSS) and di police.

''Di matter don reach di headquarters of di two security agencies so dem go fit solve am. Dem don dey settle di matter.

  ''We dey assure di members of di public say there is no cause for alarm. Una Governor dey fully protected and him go continue dey goverrn una without any wahala''.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C