On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

DSS Arraign Five People Over Kidnapping of Corp Members and Other People for Imo State

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Department of State Services (DSS) don carry five men go court for Imo State because of how dem allegedly kidnap 20 youth service corp (NYSC) members wey wan go service, join with four other people for two different matter.

Three defendants—Usman Aliyu, 25 (wey people still dey call Chonge); Babangida Aliyu, 21; and Mohammed Ali, 23 (wey dem know as Smallie Pepper)—dey face accusation say na dem kidnap those youth service corp (NYSC) members wey wan go camp on Oct. 1 along Owerri-Mgbidi-Onitsha Expressway.Di victims dey travel from Ibadan go orientation camp for Abia and Akwa Ibom State, and dem rescue them after seven days.According to di charge sheet wey dem file for Imo State High Court, Oru Judicial Division for Mgbidi, di defendants and other people wey still dey run, allegedly join hand carry di victims make dem hold them hostage.Dem still accuse them say dem carry three AK-47 rifles, four magazines, one pistol, and 81 rounds of live bullet.For another separate matter, Aminu Haliru, 27, and Tange Ibrahim, 20 (wey dem still call Jijji), dey face accusation say na dem kidnap four people around Owerri and Mgbidi on Oct. 4.Prosecutors yarn say di two of them and other suspects collect ₦8 million before dem release di victims. Dem still face charges concerning how dem allegedly carry AK-47 rifle and pump-action gun.Di prosecution write ₦8 million as money wey dem recover for di second matter. One DSS investigator and di victims na di witnesses wey dem list for both cases.Di charges include make people join hand do bad thing (conspiracy), hostage-taking, and to carry gun without permission. Court never prove say dem guilty yet o.

Comments

Add a comment

Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 31°C | Low: 20°C