Dem don arrest the Suspects of the Owo Church attack.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Chief Defence staff, General Lucky Irabor tok say dem don arrest the people wey dey behind the Owo Catholic Church attack. General Irabor tok the names of the people wey dey behind the attack as Idris Omeiza and Jimoh Ibrahim.

He siddon tok dis mata wit editors and media executives on Tuesday for the Defence Headquarters wey dey Abuja.

The Ondo State Governor wey be Rotimi Akeredolu tok say dem don arrest five suspects .

Him announce the arrest of Idris Omeiza, aka Ibn Malik on 4th August with Momoh Abubakar, Aliyiu Itopa, and Auwal Onimisi.

Dey also arrest the owner of the house where dem stay.

Peope wey die for the Owo Church massacre on 5th June reach 30 dead plus the whole nation mourn for dis mata.

The Federal Government four days after tok say, the Islamic State of West Africa Province (ISWAP) dey responsible for the attack.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C