On Air Now

Non Stop Music

Midnight - 6:00am

Defense HQ Don Post Di Photo & Names Of Officers Wey Die For Delta Community

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Defense Headquarters don release di names and pictures of di 17 military personnel wey dem kill for attack wey happun for Delta State.

Di tori be say some bad people been kill soldiers for Okuama, Ughelli South Local Government Area, afta peace mission wey don cause plenty gbege for dat side since di tin happun.

Among di people wey dem lose, na top officers dem be plus including di Commanding Officer of 181 Amphibious Battalion, Lt Col AH Ali, and Maj SD Shafa, Maj DE Obi, Capt U Zakari, SSgt Yahaya Saidu, Cpl Yahaya Danbaba, Col Kabiru Bashir, LCol Bulus Haruna, Lal Sole Opeyemi, LCpl Bello Anas, LCpl Hamman Peter, LCpl Ibrahim Abdullahi, Pte Alhaji Isah, Pte Clement Francis, Pte Abubakar Ali, Pte Ibrahim Adamu, and Pte Adamu Ibrahim.

Nigerian Army don come out for dia X account come tell all the family of the officers dem, say, "Make di Souls of di Departed Rest In Peace."

Di mata dey very sad. As di tin take be now, wetin you tink say Nigeria Army suppose do for di families of dia soldiers dem wey don kpai? Oya, come chook mouth.


 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 24°C