On Air Now

Non Stop Music

Midnight - 5:00am

Court Don Give Emefiele N20m Bail

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One Federal High Court for Lagos don grant Godwin Emefiele , di Central Bank of Nigeria (CBN) governor wey dey suspension, bail to di sum of N20 million.

Di former CBN Chief wey dem put on trial on Tuesday for one two-count charge of say him get guns and ammunition wey no legal. Him plead say he no guilty to di charges.

Nicholas Oweibo, wey be di judge wey dey on top di case tok say di charges wey dey on top Emefiele dey bailable. Dem grant di bail with one surety.

How una see di mata?
#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 22°C