On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

CAPPA dey ask for apology and justice for EndSARS victims six years after Lekki shooting

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Corporate Accountability and Public Participation Africa (CAPPA) don tell Federal and Lagos State government make dem beg for the October 20, 2020 Lekki Toll Gate shooting and pay compensation to people wey suffer for the #EndSARS protest.

Inside one statement to mark di sixth year anniversary of di protests, di civil society organisation still yab government make dem do independent investigation, prosecute officers wey do bad things, and pack well-well police reform.CAPPA beg political parties and candidates wey wan contest for di 2027 general elections make dem carry dis mata put inside dia campaign promise.Di organisation reminded people say di Lagos State Judicial Panel of Inquiry talk say di Lekki shooting na “massacre in context” and show say Nigerian Army and police enter trouble for di death and injury wey happen to protesters.Dem still call for full implementation of di July 2024 judgment from di ECOWAS Community Court of Justice, wey find Nigeria guilty say dem break protesters human rights, and order make dem pay compensation and start fresh investigation.CAPPA come yarn again say make dem give justice to journalist Pelumi Onifade, wey die after Lagos State Task Force arrest am for October 2020 while im dey cover protest mata.Di group talk say autopsy result show say na gunshot wound kill am, and dem want make dem prosecute those wey do am.Di organisation warn say police brutality still dey worry people, and dem use Tiger Base (anti-kidnapping unit of Imo State Police Command) as example, join with how security agencies handle di August 2024 #EndBadGovernance protests, wey dem say make at least 24 people die across di country.CAPPA still warn say to create state police no go solve Nigeria police Wahala if accountability no strong and dem no punish officers wey abuse power.Di things wey dem recommend include say make frontline police officers must wear body camera, make dem drop all court cases against people wey dem arrest just because dem peaceful protest, and make dem declare Lekki Toll Gate as national historic memorial.Di group come still call for national programme for justice and compensation, including make dem pay remaining compensation, and give medical and mental support to those wey survive.

Comments

Add a comment

Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 31°C | Low: 20°C