“Buhari For Don Die Since If Na Naija Hospital E Go” – Femi Adesina

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Former presidential spokesperson Femi Adesina don talk say former President Muhammadu Buhari for don die since if e bin dey use Nigerian hospitals instead of traveling abroad for medical care.

Adesina drop this statement on Tuesday during Channels Television special coverage of Buhari burial. He defend Buhari decision to always go London for treatment, say the former president don dey use London doctors before e enter office for May 2015.

“The doctors for UK already sabi Buhari health matter well-well. E no make sense to change doctor just because person become president,” Adesina talk.

The former media aide also mention say many hospitals for Nigeria no get the kind equipment and expert doctors wey Buhari need that time. According to am, if Buhari bin rely on Nigerian hospitals, e no go survive the sickness wey disturb am during e time for office.

Plenty Nigerians don always criticise Buhari frequent medical trips abroad, but Adesina say make people try understand say the foreign help actually save Buhari life, and say the criticism no dey fair.


Abuja Weather

  • Abuja

    Light rain

    High: 26°C | Low: 19°C