On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Buhari Don Come Back Abuja After im 8-Day Visit To Saudi Arabia

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

President Muhammadu Buhari don come back Abuja after im eight-day official visit to di Kingdom of Saudi Arabia, where him bin join do di Umrah (Lesser Hajj).

Di Nigerian leader bin comot go Saudi Arabia tru di King Abdulaziz international Airport jedah, Saudi Arabia, on Wednesday.

NAN report say Saudi Government officials, traditional and spiritual leaders from Naija and some senior staff of di Nigerian Embasssy wey dey di Kingdom dey di airport to tell di Presido bye bye.

Di Presido bin don perform di Umrah rituals, and tight security im follow take land for di Grand Mosque wey dey for Makkah from Madinah on Thursday morning. 

NAN still report say di presido get members of im entourage and some traditional and religious leader from di six geopolitical zones of di kontri wey pipol from di General Presidency for di Affairs of di Grand Mosque as dem follow do di rituals.

Di Nigerian leader bin don first visit some historic religious places for Madinah on Tuesday and Wednesday befre him go do di Umrah fro Makkah.

di Presido still hear about develop matas as e take dey happen for naija from some government officials wey di governors of Borno and Yobe follow dey. 

Dem bin offer prayers for peace for di kontri, di successful end of term of di Presido and for di success of di administration wey go soon enta.

Presido buhari bin don first go visit and pray for di Prophet's Mosque wey dey for Madinah.

Him bin also meet di elder statesman, correct oga of di Dantata family, Alhaji Aminu Dantata, for Makkah where he bin still  tell am pele fro im wife wey die, Hajiya Rabi Dantata.


NAN still report say di business man wey dey for Kano bin lose him wife for one medical centre fro Saudi Arabia on April 9.

How una see dis one ? #chookmouth 
   


 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 22°C