CBN Don Shift Di Deadline Wey Dem Bin Put Ontop Old Moni

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Central Bank of Nigeria (CBN) don finally shift di deadline wey pipo go fit go pay deir old moni for bank with extra 10 days for commercial banks and 7 days for CBN.

For one press tok tok wey happen on Sunday, 29th of January 2023, di Governor of CBN wey be Godwin Emefiele tok say, di new deadline na 10th of February 2023, wey we go stop to dey spend di old moni.

But Nigeria pipo go fit still pay deir moni for CBN directly until 17th of February 2023 wey dem call, ''grace period''.

Nigerian bin dey complain say dem no fit change deir moni before on di 31st of January 2023, wey be di former deadline wey CBN give. Even though, banks work to change moni for pipo inside weekend, some pipo wey dey for places wey never develop dey tok say di new money never still reach deir side.

CBN bin tok say dem no go shift di deadline before but Emefiele tok on Sunday say, dem shift di deadline because say di new moni scarce and Presido Buhari don gree make dem shift di date.

He tok say, ''di new naira wey dem change na to stop pipo from buying votes for di 2023 general election wey dey waka come for February 25 and March 11, 2023.

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C