On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Ayu talk say Ikonne's death na great loss to PDP,Nigerians

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The National oga for Pipo Democratic Party, Dr.Iyorchia Ayu don make pipo know say de death of de PDP Governorship Candidate for Abia State, Prof. Eleazer Ikonne dey shocking.

Eim pity de pipo of Nigeria, especially members of de PDP family,for de death wey dem no no know i fit happen to a man eim talk say iem be true friend and wey know many things. Ayu talk dis for de statement eim signed in Abuja, on Wenesday.

Eim say,"The doctor dey dia, until eim death for dat early hour of today, de PDP Governorship Candidate for Abia state for de 2023 general elections.

Eim be true friend,loving father and good husband who valued eim family over everything.

Eim be thorough-bred academic and administrator wey don accomplished many things

Na testimony to eim leadership acumen dat dey appointed m(for rescue mission) rector for state-owned Abia state polytechnic,Aba, 2014 and 2015. And for december 2015, eim was appointed de 7th substantive Vice- Chancellor for de Abia State University.

As iem retire for de ivory tower, Ikonne joined de PDP, and after dat dem make m Gubernatorial Candidate for de March 11, 2023 governorship election.

"I extend mai heart-felt condolences to eim family, de government and pipo of Abia State for de same time de PDP Family wey dey whole world, particular de Abia State Chapter".

"I pray for God Almighty to grant eim eternal rest and to give de family de heart to bear de loss wey no fit comot for dia mind. 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C