Atiku and PDP Don Carry Dia First Witness Come Court On Top Presidential Election Mata

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

PDP Presidential Candidate, Atiku Abubakar don carry eim first witness come court on Thursday on top di Presidential election mata.

Retired Capt. Joe Agada be di first witness wey PDP carry go court on top Presidential  Election Petition Court(PEPC)for Abuja.

Di witness Joe Agada tell court say eim sign election results sheets by force for Kogi state.

Agada still tell court sa na by force oda agents of oda parties take sign election result sheets for different polling units fro that state. 

Retired Capt. Joe Agada be di Kogi state collation Officer for PDP for di Febuary 25 presidential election. He still tok say eim dey there for different polling units wey e see say dem dey do mago mago for di BVAS.

PDP and Atiku tok say dem go challenge di election results for only 18 states.   

How una see di mata ?

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 24°C