On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Area Boy Don Kill One Bus Conductor

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One area boy kill bus conductor becos of money wey him won collect for police pipo.

One area boy wey dey work for police pipo wey dem dey call Daramola Olanrewaju, don kill one bus conductor wey dem dey call Michael becos of N500 'police fee', wey he dey collect for police pipo for Ketu Bus Stop, Lagos State. Him bin dey work for di police pipo wey dey Ketu Police Station when di wahala wey kill di bus conductor happen for Friday wey be February 3.

PUNCH Metro tok say, di wahala start when di bus conductor no gree give di area boy di N500 'police fee' wey every bus wey dey pass Ketu side dey pay.

One persin wey see as di whole thing happen, tok say, as di conductor no gree pay, na im di area boy come drag am from di bus, di conductor come fall down, na so anoda motor wey dey come jam di conductor. Dem tok say, di conductor, wey be Michael, die before dem even reach hospital.

One bus driver wey be Taiwo Akanni, tok say dem dis area boys wey dey work for dis police pipo don dey dey too strong and him tok say dis, no be first time wey dem go drag bus conductor down from motor wey dey move, e just bad say di man die. He tok say dem dey even treat dem anyhow for front of deir oga, wey be di police officers.

“Dem need to stop! Di power wey dis police pipo don give dem dey too much and na why we dey get dis kind issue.”

 Lagos State Police Public Relations Officer, SP Benjamin Hundeyin, don confirm di whole yawa and him tok say dem dey chook eyes for di matter.

He tok say, “di area boy dey deir hand, him name na Daramola Olanrewaju and him dey 30 years old and “for di pipo wey tok say di boy dey work for police pipo, we dey chook eyes for di matter too''. We still get di driver of di motor wey kill di conductor with us.

''Di area boy and driver dey for Ogudu area command. Na di area commander na im dey handle di case.''

#chookmouth

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C