African Democratic Congress (ADC) don release new timetable for im 2026 primary elections, and dem don adjust nomination fees after dem consult party stakeholders.
The African Democratic Congress(ADC) don release their party timetable for 2026 primary elections, dem also drop new nomination fees after dem don discuss with party stakeholders.
For inside statement wey their National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi make, E talk say to buy and submit their nomination form na from 6th to 13th May, E also talk say screening na 14th and 15th May.
ADC party talk say dem go release results of the screening wey dem do on 17th may, say dem go also hear appeals wey any candidate get between 18th and 19th may.After everything dem go get final list of people wey dem don clear on 20th may.
For inside wetin dey the new schedule, dem talk say primary elections for Senates Houses of Assembly, House of Representatives and Senate seats go hold on 21st May,Governorship primaries go follow behind on 22nd May
Dem go wrap up everything with National Executive Committee meeting on the 25th May and dem go hold special national convention on 26th May for final validation.
The party also talk say dem get new fees for nomination forms, say presidential form na 90 million naira, governorship form na 30 million naira,senate form na 10 million naira, house of reps na 5 million naira and state house of assembly na 2 million naira.
Dem say the concessionary policy still dey ground,youths between 18-35 years get 50%, while women and people with disabilities get 25% to use collect forms.
Dem talk say all these adjustments na to increase the power of internal democracy and to make access dey easy, so that participation go dey smooth as dem dey prepare for 2027 general elections.