439 doctors wey go skool abroad don fail our medical exam - MDCN

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Medical and Dental Council of Nigeria don come out to come yarn say 439 doctors wey learn the work for abroad don fail the medical exam wey dem set for dem to know if dem really sabi the work.

Dem do exam on November 23 and November 24, 2022, for Usmanu Danfodiyo University Teaching Hospital, Sokoto. 

The council’s Registrar, Dr Tijani Sanusi, tell tori pipu say 916 doctors wey learn the work abroad naim siddon to write the exam but only 477 candidates come pass the exam.

Dr Tijani tok say 24 of dem siddon for the exam for Dentistry and only 8 pass am, the remaining 16 fail the exam. Out of the 892 wey write to be medical doctors only 469 pass the remaining 423 fail.

Eim come still yarn say na the same thing dem dey teach person wey wan be doctor for everywhere inside obodo the world. Na anybody wey wan do the work must pass the exam.

E no matter of the person na  Professor of Medicine for we obodo naija or obodo United Kingdom abi na United States. e no still mata.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C