2023 Presidential Election: Kwankwaso Don Win For Kano

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Independent National Electoral Commission (INEC) tok say na di presidential candidate of di New Nigerian People’s Party (NNPP), Rabi’u Musa Kwankwaso na im win di presidential election for Kano State.

Di State Collation Officer for di Presidential Election (SCOPE) for di state, Prof. Lawal Suleiman Bilbis, na him tok dis one immediately after dem gather di whole results from di 44 local government area for di state.

Di NNPP win for 36 local government area out of di 44 local government areas wey di state get.

Di party get 997,279 votes, na im him take beat di presidential candidate of di All Progressive Congress (APC), Bola Ahmed Tinubu, wey get 517,341 votes after him don bin win for di eight local government areas.

Prof. Bilbis still tok say, di presidential candidate of di People’s Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar get 131,716 votes, and di Labour Party (LP) candidate, Peter Obi get 28,513 votes.

Kano get 5,792,448 pipo wey register to vote and out of  dem na 1,769,525 voters na im come out, come vote for di presidential election.

Di result show say di total votes wey pipo cast na 1,746,410 and out of dose votes, dem reject 44,405 votes. Di correct votes wey dem come gather na 1,702,005 votes.

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 23°C