Wydad Don Beat Al Ahly As Dem Win CAF Champions League

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

CAF champions league wey be one of the biggest club competition inside we obodo Africa don get new champions. Wydad Casablanca kpopo Al Ahly 2-0 wey come make dem CAF Champions League winners

The final wey dem play for inside The Stade Mohammed V for Morroco, wey be Wydad's dia home ground make Al Ahly first dey para for CAF because dem feel day e go give Wydad home advantage. Dem even carry the mata go Court of Arbitration for Sport, the court troway the mata. Wey come make Al Ahly chief executive Amr Shaheen tok say "Sport dey about fairness, equality and fair play: this na our objective and e suppose be  CAF own sef,"

E come be like say dem see vision, because the way Wydad fans packed the Mohamed V stadium e fit make fear catch the Al Ahly team.

Wydad Casablanca winger Zouhair El Moutaraji, naim score the two goal wey help eim team become CAF champions league winner.

This one come make am the third time wey Wydad Casablanca go win the title as dem don win am before for 1992 and 2017. And this win mean say dem stop Al Ahly make dem no win am back three times back to back as na dem win for both 2020 and 2021.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C