On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Shooting Stars Assistant Coach Akin Olowokere Don Die After E Collapse for Training

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian football family dey mourn as tori reach say Akin Olowokere, wey be assistant coach for Shooting Stars Sports Club (3SC), don die sudden.

Olowokere, wey just join di club coaching team recently, collapse for pitch during di team morning training on Monday. Dem rush am go hospital sharp-sharp, but doctors talk say im don die as dem reach.

Up till now, dem never announce di official cause of him death. People wey dey there talk say di coach just slump for field, dem carry am go nearby hospital but all di effort to save am no work.

Shooting Stars Sports Club don drop official statement to confirm di sad news.

For di statement, di club hail Olowokere as dedicated, passionate coach wey be mentor and father figure to many of di players. Dem send condolences give him family, friends and di whole Nigerian football family.

Olowokere bin join di team under new Technical Adviser Nurudeen Aweroro as part of Shooting Stars preparation for di new football season.


Abuja Weather

  • Abuja

    Heavy Rain

    High: 25°C | Low: 20°C