NFF go host annual congress for Lagos on Thursday 18th August 2022

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di members of NFF congress go do parapoism tomorrow for inside Lagos as dem go gather to arrange how di NFF elections go take go.

 

Tori wey we dey hear from NFF be say di meeting go happen for Best Western Plus hotel for Victoria Island, Lagos as e be say, di Chairmos and di Secetarys dem of all di FAs for di 36 states and F.C.T football join-bodi go agree when dem go do di NFF elections

Di leagues coaches association, players union and referees join-bodi dem, go follow show face for dis congress.

Amaju Pinnick wey don be presido since 2014 don tok say eim no get any ambitions to run for 3rd term dis year, say eim wan open di door for new leadership.

Ontop di matter, Pinnick still promise say him go support di new President, make sure say him get beta sabinus to take run di NFF.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C