Barcelona fit relegate go Europa League dis season

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Barcelona loss to Inter Milan for di 3rd time in history fit give the spanish side plenty wahala dis season for Champions league

Barcelona as a football club dey bounce back from di financial problems wey dem be get earlier dis year and as e be, dem go do another bouncing back as a team if dem wan qualify for second round of UEFA Champions League.

Inter Milan on Tuesday for San Siro win di in-form Barcelona team 1-0 with a beautiful goal from di turkish player Hakan Calhanoglu, just before half time.

Di match however bin dey very controversial as Xavi di Barça coach bin complain over poor refereeing decisions. 

Right now, Barcelona dey standa for 3rd posi with just 3 points. If dem no wan relegate go Europa, dem must to double up because as e be, space no dey again for errors.

Bayern Munich and Inter Milan dey top di group as 1st and 2nd in that order while Viktoria Plzēn dey sidon for last posi.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C