| AC Governor ,person 4 2007 wey no see d power collect 4 Ogun State,Dipo Dina,don kaput |
|
|
|
|
AC Governor ,person 4 2007 wey no see d power collect 4 Ogun State,Dipo Dina,don kaput. Plateau state command of we nigeria police don confirm say 362 people don kaput 4 jos gbege. Lebanon Defence Minister talk say na bad weda na am cause wey that Aeroplane take jump enta water yesterday. Prime minister Jean-Max Bellerive say Haiti dem fit recover 4 d ground wey shake. AC governor person 4 2007 wey no see power collect 4 Ogun state,Dipo Dina,don kaput after bad people take on am yesterday night 4 near Sango Otta. Security people,say Otunba Dina bein dey go him house 4 Lagos from Abeokuta b4 d bad people come jam am 4 road,one of him people talk say him kaput after dem wound am wit gun. We minister 4 obodo oyibo mata,Ojo Maduekwe don say we presido Umaru Yar’Adua go soon come back e no go tire.Him come say,say we law book no give we presido power make him make way 4 him vice 4 dis kind mata wey him no dey.him too come shake bodi 4 d mata wey big court 4 Abuja say d dey give we oga dem 14 day make dem tell us how we presido bodi de,say wen dem reach dere dey go cross am. Meanwilly governor 4 Niger state Babagida Aliyu don tell we people say make dem follow we law book so dat peace go dey,him say make dem take easy and jeje wit respect 4 dis mata,say we lawbook don tell us wetin we go do if dis kind mata comot face. Police Inspector-General Ogbonna Onovo don talk say make we country people no wetin dey d hear and swallow so dat e no go damage we country,say him don sit don look dis mata and e no good wetin we people de do,were e pain pass na 4 dis jos mata. Meanwilly,Plateau State command 4 naija police don say all d people wey kaput 4 jos na 326 dey dey.The don send 139 out of d 313 people wey dey suspect say na dem carry jos mata 4 head,go Abuja.police say d mata no be religion mata say na people just use dat one d cover. AC don say dis religious wahala wey dey happen everytime don too much say d only way wey de go stop dis mata na make dem do wetin dey suppose to do to d people wey dey cause dis wahala.AC dem write write 4 talk don talk say if dem no stop dis thing,say dem go d waste dem time to think say US go refu dem name from dere black book. B4b4 presido Yakubu Gowon don say him no wella say dis kin gbege wey happen 4 jos no go happen again,him talk 4 plateau state wey dem hold meeting 4 big people wey get mouth 4 jos wey dem governor Jonah Jang hold. Foreign matterLebanon minister 4 defence mata,Elias Murr say Ethiopia dem moto 4 up wey jump enta water 4 Beirut say e fit be bad weda wey cause am.say dem only fit know wetin cause am if d find d black box wey d follow d moto.Dey d fear say all d 90 people wey dey d moto 4 up kaput,but d don see 24 bodi and dem still d look both inside water. Prime Minister Jean-Max Bellerive say Haiti government fit still do sometin 4 dem place no matter say their country shake say make dem put dem sef together,him come tell oga dem 4 world 4 Canadian city of Montreal say the need supoort international community,don come gree say d go do sometin 4 dem headquarters 4 New york 4 March. sportsSuper Eagle dem coach Amodu Shuaibu don say him no say him boys no play fine 4 dem quarter final match wit Zambia.him talk am 4 Lubango,Angola and him say if to say dem no win say wahala 4 dey 4 dem image but say thank God say dem win and dey go correct all d tins wey no right b4 d meet Ghana 4 dem semi final. |















Top 10

