|
Meanwhile, INEC chairmo, Attahiru Jega, don say make we federal government range N74 billion before two weeks make them for fit range new book wey the names of people wey go vote go dey inside. Oga Jega talk this one yesterday when him do sidon talk with the joinbody for we house wey de range law on top election matter. Him say the one wey dem get now, e no go reach at all to take do election wey no get wuruwuru. Meanwhile chairmo for this joinbody for we house wey de range law on top election, Musa Sarkin-Adar, say if them give this money, make dem make sure say the election no go get wuruwuru at all.
|