| Acting congress don tell Acting Presido Jonathan say him comot d Chairman of INEC |
|
|
|
|
Acting congress don tell Acting Presido Goodluck Jonathan say him comot d Chairman of INEC,Maurice Iwu. Dem National Talk Seke,Lai Mohammed don talk say Prof.Iwu don become danger 4 we Nigeria and we democracy. Meanwilly,INEC don approve about #5 billion 4 to take do d review and revalidation of voter,wey dem suppose begin register 4 April 19 reach June 19. Dis waka go b d biggest one wey go sele since wey dem dey take plan 4 the next general elections wey go sele 4 ending of dis yearor beginning of 2011 and dis one go depend ontop the the constitutional amendment wit d 2006.Electional Act by d National Assembly, Acting Presido Goodluck Jonathan 4 yesterday don show say Federal Govament serious ontop to take do free and beta election 4 inside 2011. Informate Minister,Dora Akunyili wey represent Dr Jonathan 4 d Awards nights talk say we Acting Presido don promise say Govament go do beta waka ontop dis election mata. Prof Akunyili talk say even say Nigeria get plenty gbege,say terrorism no dey 4 inside at all. NNPC don request say dem need assist to take protect oil and gas pipeline,also dem don begin waka ontop to take clear block block inside dem shell pipeline wey go warri refinery to take avoid d closedown of d gas plants. NNPC Group Managing Director,Mohammed Barkindo 4 inside letter wey him write give Defence Minister Godwin Abbey,talk say waka important 4 blackout 4 no deyy we country. Meanwilly Minister of state 4 Foreign Affairs, Bagudu Hirse,wey bin dey dey one ECOWAS meeting don show concern ontop Presido Mohamoud Tandja wit him cabinet people. Ambassador Hirse talk say d coup wey sele say na middle cadre military officers do am and say d senior officers no support d waka. However d leaders of d military coup 4 Niger don promise constitutional return 3 days afta dem overthrow Presido Mamadou Tandja. One talk person 4 d coup leaders talk say dem go do new constitution wit election bt dem no talk when e go sele. Delegate people from U.N wit ECOWAS don dey Niger to take do meeting wit d junta Rescue work people dey Portuguese Island of Maderia afta d flood wey kpai atleast 42 people more than 120people don wounjor and say plenty people still dey miss,wey b say plenty people people fit still kpai. |














Program

