Coolfm and Wazobia T-shirts

Sticker for T shirt ( when presenter says Sticker for T shirt call us and tell us you have the new combined cool wazobia sticker and we will deliver to you a T shirt after verification).

Search

Custom Search

Naija's Top 9


1.
P SQUARE
DANGER

2.
WANDE COAL
I KNOW YOU WANT IT

3.
BRACKET
YORI YORI

4.
AY-COM FT TERRY G
PASS ME YOUR LOVE

  View all Top 10

Schedule! Who's on the air at what time? It's all here!

Who's Online

We have 177 guests and 70 members online

Visitors Counter

mod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_counter
mod_vvisit_counterToday905
mod_vvisit_counterYesterday1786
mod_vvisit_counterThis week7938
mod_vvisit_counterLast week9344
mod_vvisit_counterThis month43263
mod_vvisit_counterLast month49004
mod_vvisit_counterAll763974

Online (20 minutes ago): 153
LIVE Streaming!
Fed Govt talk say d light supply wey spoil say na people wey dey go spoil pipepline. PDF Print E-mail
Federal Government talk say d light supply wey drop from 3,710 mw go 2,400 mw 4 inside December 2009 reach now say people wey dey go spoil pipepline dey cos all dis one.

Power Minister,Remi Babalola talk dis one afta meeting wey him do wit d National Integrated Power wey na Acting Presido sit down ontop d meeting.

Dr Babalola tell news people say na d pipepline wey bad belle people dey spoil,na him do make shortage dey 4 inside d supply of gas 4 d 10 power stations 4 we country.

NNPC don promise say from now say dem go begin supply 12,55 trucks of 41.4 million litres of fuel everyday to all d petrol stations 4 we country.

NNPC Group General Manager,Corporate Affairs,Levi Ajuonuma talk say dem don do beta task force to take commot que for inside we major towns.

Him say the task force don dey arrange as dem dey take load and supply fuel for filling stations

Science and technology Minister Alhassan Zuku talk say developing country dem nor dey do reach to take do make development for dey indide science and technology. The minster talk dis one yesterday for dem first consultative forum wey b meeting with the heads of universities and some science sabi people.

Dr. Zaku talk say developing country dem suppose dey invest reach at least 1% of dem Gross National  Product wey be money wey dem wan spend 4 ontop science and technology every year to take fit see say e dey grows

Senate people 4 yesterday bin dey find as dem go take remove section 144 for inside 1999 constitution.

Dis one sele as FEC people no gree do anything ontop d waka wey Presido Umaru Yar’Adua do wey him no tell dem b4 him go.

Plenty from inside d senator dem talk say dis one dey happen becos of how politics bin dey 4 we country,deputy senate presido,Ike Ekweremadu na him bin read d general bill wey be new law.

One week afta House people bin return from Saudi Arabia,we still neva hear any report of dem waka.

Yesterday,Minority Leader,Mohammed Ndume dey 4 front of people wey dey para say why dem neva carry d report give d House.

Hon,Ndume,wey himself dey 4 inside d people wey go Saudi Arabia,talk say dem tell am say d report go reach d House yesterday afta dem don sign am.

Coup don sele 4 inside Niger and say dem don kobbi d Presido afta plenty plenty gun gbege bin sele 4 Niamey wey be Niger capital.for inside one TV announcement,one talk person 4 d people wey plan d coup talk say dem don suspend Niger Constitution and say dem don dissolve all d state offices.

D talk person talk say na one group wey b d supreme council 4 d restoration of democracy na him dey for front of d coup.

Tori dey say dem belive ssay dem kobbi Presido Mamadou Tandja inside one Military barracks