Coolfm and Wazobia T-shirts

Sticker for T shirt ( when presenter says Sticker for T shirt call us and tell us you have the new combined cool wazobia sticker and we will deliver to you a T shirt after verification).

Search

Custom Search

Naija's Top 9


1.
P SQUARE
DANGER

2.
WANDE COAL
I KNOW YOU WANT IT

3.
BRACKET
YORI YORI

4.
AY-COM FT TERRY G
PASS ME YOUR LOVE

  View all Top 10

Schedule! Who's on the air at what time? It's all here!

Who's Online

We have 176 guests and 70 members online

Visitors Counter

mod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_countermod_vvisit_counter
mod_vvisit_counterToday905
mod_vvisit_counterYesterday1786
mod_vvisit_counterThis week7938
mod_vvisit_counterLast week9344
mod_vvisit_counterThis month43263
mod_vvisit_counterLast month49004
mod_vvisit_counterAll763974

Online (20 minutes ago): 152
LIVE Streaming!
All We State Govanors Don Standa Well Well For Acting Presido Back PDF Print E-mail

D 36 state govanor dem don show say dem standa gidigba for d back of we presido for now, Goodluck Jonathan for make im dey range things for inside we country. Chairmo, of d govanor dem comitee, Bukola Saraki, na im do dis talk for yesterday afta dem do meeting for back of door wit Dr. Jonathan.

Dr. Saraki talk say d comitee dem dey worry on top as some FEC memba dem dey take talk say dis kain talk fit dey show say gbege dey inside we country govament.

 

Meanwhile, UN seke-general, Ban Ki-Moon don show say im dey we presido for now back well well. Mr. Ban come tell Nigeria people say make support Dr. Jonathan govament to take fit change all d gbege wey don sele ontop presido Umaru Yar’Adua sickness.

 

Meanwhile, House of Representatives don tell Nigeria pple say make dem serious for ontop thigs wey go do beta inside we country peace and unity.

D representatives dem do dis one inside meeting wey long reach 2 hours for back of door. Tuned Akogun naim do dis talk for the floor of the house.

 

Nigeria 9 year old twins dem for yesterday don b d youngest students dem to take enta sconsdary school for Britain. Paula wit Peter Imafidon bion don break world record wen dem bin pass one A/AS Level maths for 7 years.

D twins bin go normal state primary school but say more than 12 ogbonge schools wan give dem admission.

 

Chile presido,  Michelle Bachelet don beg say make people wey dey for Concepcion where d earthquake bin happen, say make dem smpe, sake of say military people don dey ground to take protect them from all dis theif theif people.

She talk say 14,000 soldier don dey dere, afta some people go theif for dat side. Dem don do make people no dey waka comot from dem house for inside 4 town dem inside Chile plus anoda one for Concepcion of 18 hours.

Nearly 500,000 people nor get house again inside d town wey military people don dey control.