| Acting Presido Goodluck Jonathan talk say Nigeria don standa gidigda 4 2011 election |
|
|
|
|
Acting Presido Goodluck Jonathan talk say Nigeria don standa gidigda to take fit do better pass Ghana 4 inside elections wey go sele 4 2011. Dr Jonathan talk dis one 4 wen him dey welcome b4b4 presido of Ghana,John Kuffour 4 d state house 4 Abuja. Tori wey dey 4 Nigeria and Saudi Arabia yesterday,show say d FEC wey waka go see Presido Umaru Yar’Adua,say dem no go see am. Tori dey,say doctor dem 4 Saudi don carry letter give Federal Govament ontop as wey Presido bodi b and say person no go fit see d presido. Meanwilly,AC talk say Saudi authority dey insult Nigeria,ontop d one wey dem no gree Nigerians see Presido,wen dem don know say dem no go gree dem see am,4 where him dey follow we talk person Ijeoma Okoye talk,Alhaji Mohammed talk say dis wey Saudi people dey do so,na hostage dem hold am 4 dere. Federal Govament wit organized labour people don gree to take do committee wey go range d mata of deregulation of we oil industry. This one happen afta d waka wey National Presido of NLC,Abdulwaheed Omar wit presido General,Trade Union Congress,Peter Esele wey dem go meet Acting presido Goodluck Jonathan. Tori don dey say representatives of labour go follow 4 inside d committee. Meanwilly,federal govament don declare Friday,February 26 as public holiday to take mark we muslim brothers their Id-el Maulud festival. Minister of state 4 inside,Ademola Seriki na him do dis talk 4 yesterday,him wish all Nigerians 4 home and away beta holiday and say make dem do beta as prophet Mohammed teach dem. Ivory Coast Prime Minister Guillaume soro go announce new govament afta one talk wit him opposition Ivorian Presido Laurent Gbagbo bin use vex pursue him b4b4 govament people 4 february 12. Atleast 3 people bin kpai yesterday 4 inside protest wey dem do 4 street,dem kpai 2 people 4 Daba wen soldier dem bin shot gun ontop d protesters. US Presido,Barrack Obama don do new plan to take range US healthcare sector,na the first wey Presido Obama go talk the mata by himself gong on,4 Thursday him go hold bipartisan talks 4 dem White House 4 d mata.  |
















Presenters 

