 | | More pictures | | |
MATSE My name na Matse. I be very creative person wey like to dey read, write and I sabi cook and draw well well, nor try me with AMIEDI and starch O! You go just chewing gum me for life (laughs) . I come from Warri and I dey proud to be WAFFI...We nor dey carry last at all, at all! Music na wetin I nor dey take play...I dey feel am,dey smell am, dey touch am,dey see am and dey taste am. Na so I take land for radio station. Nor be by mistake,na wetin Baba God don arrange and I dey grateful. I be person wey people nor dey quick understand but once you sabi me...you go love me for life. I like music wey get plenty creativity inside, na im make I like Asa, Youssou Ndour,Baba Maal,Samite and Salif Keita. My family and friends get guy name wey dem dey call me...na lady. That na because of the way I dey waka and behave and I like fashion nor be small. I be person wey people dey respect and admire and I dey fear Baba Godé gan! I believe sey plenty opportunity dey for world but na your hand e dey to do wetin you feel sey good for you. No lose your dreams at all, at all because if you nor get dream,your own don finish. Remain Coolèlè!
|