|
Still on election matter, INEC chairmo, Attahiru Jega, don knell down beg we olopa them say abeg, jooo make them make sure say nobody steal we ballot box. Oga Jega talk this one yesterday when him go visit oga kpatakpata for olopa them, Ogbonnaya Onovo, for Abuja. Oga still yarn say them don start the waka to take range new book wey the names of the people wey go vote go dey inside. As oga Onovo de answer we INEC chairmo, him tell am say make them just go house go sleep sake of them don dey kajadly kajad to take make sure say we election clean like pure water.
|