|
Abia State Governor, Theodore Orji say P.D.P party dey wine am make him return back to dem party after him don comot there for 4years. Sabi sabi person for tori media to Governor Orji, Ugochukwu Emezue say after P.D.P people come talk to Governor Orji to come back. Governor Orji don say him go go talk with people wey get mouth for dem State on top the matter before him make up for the matter. Oga Emezue tell our tori person Ijeoma Okoye say Governor Orji say him go make up him wetin him go do after him do talk to the ogbonge people for the State
|