| Presido Umaru Yar’Adua don come back Nigeria today |
|
|
|
|
Presido Umaru Yar’Adua don come back Nigeria 4 early today,him don use reach 93days 4 Jeddah,Saudi Arabia ontop him bodi mata. Him plane wey b ambulance wey land 4 Nnamdi Azikwe International Airport,Abuja 4 around 1.47am. Meanwilly oga govament people plus d FCT Minister,Adamu Aliero,bin dey d airport to take welcome am. B4 him bin reach,nearly 200 soldier and police people bin dey d presido side 4 d airport. We ogbonge govament don gree to take spend #19,billion to take repair land wey water bin spoil 4 inside Niger Delta. Dis one happen 4 inside one meeting wey we presido 4 now Goodluck Jonathan bin dey d front inside d State House,Abuja Senior Special Assistant ontop talk talk to d presido 4 now,Ima Niboro talk say dem go release d money ontop d one wey dem call Special Intiernation Fund. Dem don warn Armed Robber people say make dem commot Lagos,as d state govament talk say dem ready 4 dem well well. Governor Babatunde Fashola talk dis one 4 yesterday wey dem launch 10 Armoured Personnel Carriers,wey b moto wey gun nor fit enta am and na d State Security Trust Fund na him give dem dis one to take fight thief people. Sudan Presido Omar al-Bashir don do say dem go stop dem fight wit one of Darfur oga nor gree people,wey b d Justice and Equality Movement. JEM Oga Khalil Ibrahim talks say dis one important 4 to fit get peace,but say dem go need get beta patience b4 dem fit get head inside d waka. Latin American and Caribbean people don gree to do one new waka wey US and Canada no go dey inside. D OAS bin don get gbege wit some of him people and US ontop economic policy,wit market mata and say dem bin dey do make d thing 4 favour US. |















Presenters 

