| Oga Jonathan don Approve Special Advise People as SNG Prepare for Para Waka |
|
|
|
|
We presido-for-now, Goodluck Jonathab for yestaday bin find Senate approval to take carry 5 special advise people join d one wey bin dey. Dr. Jonathan talk inside letter wey im write go give senate presido, David Mark wey im say im need d special advise people dem, sake say im work don increase as we for-now-presido. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: Plateau State Governor, Jonah Jang don carry accuse give military commander dem ontop say dem nor do anything afta im bin tell dem say gbege go dey for Sunday inside Jos. Plenty people bin kpai for inside 3 village dem wey nah Christian people for south with muslim people for north Govanor Jonah, wey b b4b4 military officer talk say im b warn d army people ontop report wey im get ontop people wey carry difrent difrent weapon dey waka b4 d gbege bin shele but say dem nor do anything ontop d report. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: Oga pata-pata, Ogbonna Onovo don promise d Save Nigeria Group, Future Nigeria Group wit Jamaftul Nasril Islam ontop d security make agbero people for nor use d waka take cos gbege. Im talk say since say to protect law naim b police work, say dem nor go fail d their work. But Police Commissioner, FCT Command, Haruna John, don hala swear dem nor go gree make d para waka happen for dere. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: The driver of d truck wey kpai 19 passenger for Ijebu-Ode – Sagamu expressway for July 31, 2009, don show face yestaday for d senate comitee ontop thief-thief mata wit security. Osayande Idahosa talk say im nor know say nah passenger dem bin dey for road, say im b think say nah wetin thief people dey take block road to take rob people bin dey road. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: US state department don apologize ontop wetin dem bin talk ontop wetin Libya leader, Mummar Gaddafi talk ontop Jihad or Holy War against Switzerland. Dem talkperson, P.J. Crowley wey do dis talk say d talk bin nor folo US policy and say dem bin nor wan offend person. Col. Gaddafi don para give Switzerland vote against d tall prayer house wey im bin tell muslim people 4 there say make dem nor gree ontop d waka. Mr. Crowley talk say d talk nah mistake talk. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: United Nations Seke General, Ban Kimoon don carry salute give d 101 UN hero dem wey bin kpai for inside d Haiti earthshaky shaky for inside one ceremony for New York. Mr. Ban wey im voice bin dey shake wen im bin dey talk say dem nor go ever forget dem. Meanwhile, Haiti Presido, Rene Preval dey Washington to take look for help from US Presido, Barack Obama to take repair Haiti economy. Mr. Preval talk say dem don complete d first waka ontop d gbege wey bin shele for January. |















Marketing

