| FEC Postpone Im Meeting Yestaday and Obama Don Promise Say US Go Helep Haiti Well Well |
|
|
|
|
FEC for inside yestaday bin postpone dem meeting sake of say we for-now-presido nor get chance at all. Seke to govament of d federation, Yayale Ahmed bin do d talk ontop d meeting for inside d council chamber for d presidential villa, Abuja. Alhaji Yayale talk say dem postpone d meeting bcos say presido-for-now nor get chance at all, wey b say im suppose dey front on d meeting.   Member dem of Save Nigeria Group don tell we presido-for-now, Goodluck Jonathan say im begin do quick waka to take comot d chairmo of INEC, Maurice Iwu. Tunde Bakare wey dey front of d waka, talk say d group dey demand say make dem range INEC after dem don comot Prof. Iwu, make d bad belle people for follow am comot. D group dem for inside wey dem write go give d presido for now wey dem tell am say make change d people wey dey d Federal Executive Council.   Senate don talk say dem nor get sabi say dem nor gree d Save Nigeria Group to take enter inside d National Assembly to take do dem para waka. Vice chairmo ontop senate comitee ontop informate, Anthony Manzo talk say National Assembly dey open for anybody wey wan do any peace para waka and im come talk say im regret wetin happen.   Nigerian Army don talk say dem nor get hand inside d last Sunday gbege ontop d 3 community of Dogo Na Hauwa. Ratsat and Jot for inside Shen Village of Jos South Local Govament Area. Dem Director ontop informate, Chris Olukolade, talk say d talk wey Plateau State Govanor, Jonah Jong do so, say d talk nah embarrass talk. In come join talk say d talk nah to take caus gbege give Army people.   Lagos State Police Public Mata person, Frank Mba don tell people for inside d state say make dem continue to dey supply informate wey go helep dem do dem work. Mr. Mba for inside talk wey im do wit we talk person, Johnson Ayedun , im say if dem dey get dat kain informate, say e go helep dem wounjor criminal people. Im com promise say dem go treat all d informate as secret, wey no oda person go know as dem take get am.   Campaign people talk say b4b4 rebel dem for inside d Democratic Republic of Congo wey dey for inside army now don dey do anyhow for inside d mine dem. D b4b4 rebel dem of d CNDP group dem don get power pass as dem bin get ontop d mine wen dem stil b rebel. Campaign group, Global Witness talk say d govament wit oyinbo community dem don fail to take comot gun from d rebel dem hand for inside d mine.   US presido, Barack Obama, don warn say anoda gbege go shele for inside Haiti wey im tell d people say make dem nor think say d gbege don finish. Presido Obama talk say afta 2 months wey ground bin open swallow everything never range for dat side. Im tell Haiti Presido, Rene Preval say US go continue to helep Haiti to take repair and rebuild wetin bin spoil inside Haiti. |

















