| Gbege Don Start Again for Jos Side |
|
|
|
|
Anoda gbege don shele yestaday for Dogon na Hawa, wey b one village inside Jos South Local Government Area of Plateau State wey plenty people don kpai inside. 150 naim kpai for inside d gbege wey shele for early morning yestaday. Gbon Gwon Jos, Jacob Buba talk say dis one nah man wickedness to fellowman. Im com add talk say security people don ang go dat side. Meanwhile, State Inforate Commissioner, Gregory Yenlong, talk say d gbege nah wickedness weyman do give im fellowman. Im beg NEMA wit oda helep the people wey theirhouse and food bin burn, don dey uffer lenty hunger. Mr. Yenlong talk say the State govament go do mass burial give the victim dem en de on see all dem dead body. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: Oga pata pata of Police, Ogbonna Onovo don go meet we presido, David Mark. D meeting wey im do wit Senator Mark nah part of the waka wey we presido-for-now dey do to take do beta govament ontop all dis gbege wey dey happen for Jos. Dr. Jonathan don tell all d security oga dem say make them carry report come give am ontop d gbege, as e take shele. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: NLC don talk say dem go do para waka to take do make dem for comot INEC chairmo, Maurice Iwu. According to d NLC people, dem say nea becos say oga Maurice Iwu nor dey fit perform make we for fit dey get election wey nor wuru wuru inside am. The NLC talk say dis one nah part of the one wey National Executive Council decide say dem go carry the NLC talk go meet we for-now-presido wit the Natinal Assembly. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: The Conference of Nigeran Political Party (CNPP) dem do tell we for-now-presido say make im carry quick waka to take do d rangement ontop election. The group dem do dis one ontop as some ogbonge Naija people take dey complain ontop d mata. For inside one talk, dem talk-talk person, Osita Okechukwu say CNPP talk say if beta arrange nor dey inside we election, say beta arrange nor dey inside we election, say beta democracy no go dey. ::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::: D main I-nor-gree party for Togo talk say dem gree for inside d election result wey carry Presido Faure Gnassingbe enta power again. The Union of Forces for Change talk say plenty wuru wuru dey inside d election and say dem go challenge d result for dem country constitution court. The party talk say dem leader, Jean-Pierre Fabre bin win d election and say im go do d next govament. Mr. Gnassigbe nah d pikin of dem ruler wey don die. Two building bin destroy for inside Baghdad, while gbege bin dey shele for inside Mosul, Falluja, Baquba wit Samarra. |

















