| Acting Presido don b the new chairmo 4 ECOWAS 4 inside d election wey dem do yesterday. |
|
|
|
|
Acting Presido Goodluck Jonathan don b the new chairmo,Economic Community of West African States authority 4 inside d election wey dem do yesterday. Dr Jonathan 4 inside him acceptance talk,him thank dem well and say Nigeria re-election don show say ECOWAS still get faith and confidence 4 we country. Dr Jonathan carry hand pack chest,say Nigeria still dey strong and say Nigeria still belive d west Africa institution peace,unity and progress go front. B4 b4 chairmo of EFCC, Nuhu Ribadu don salute Dr Goodluck Jonathan ontop Acting Presido wey him b. Mallam Ribadu talk say dis one wey national assembly,do so don show say beta don enta Nigeria and say God don favour us, Senate don talk say dem no hold FEC people by condition ontop presido Umaru Yar’Adua.some newspaper yesterday report say d senate issue 48hour condition to FEC to take decide ontop presido yar’adua or say dem go begin waka ontop to take impeach am. But senate presido David Mark talk say senate no get power to carry condition give FEC people and say senate no carry condition give senate as some talk talk paper people talk. Meanwilly senate committee ontop public account 4 yesterday warn say dem go sanction d coordinator,National Poverty Eradication Program,Magnus Kpakol,committee chairmo,Ahmad Lauran talk say Dr Kpakol don fail to answer dem ontop question wey d office of d Auditor General of the Federation carry give am. However d 5 member house of representative delegation wey go Saudi to take go see presido Yar’Adua go summit dem report tomorrow.Minority Leader of d house,Mohammed Ndume,confirm say dem no see d presido.however,d leader of d delegation,Baba Sheu-Agaie,no gree talk ontop d mata wen newsmenbein meet am. E.U don renew dem sanction against Zimbabwe 4 anoda 12months,B4b4 enemies Presido Robert Muyade and Prime Minister Morgan Tsuangirai join bodi 4 last year,but dem neva too gree 4 demself. D EU ban target 200 people and 40 companies wey Mr Mugabe Zanu.PF get hand ontop mata of abuse of rights.some of mr Mugabe people no gree 4 inside dis talk. Presido Barrack Obama don announce say more than $8 billion of federal loan do give sign of take build US first nuclear power station 4 30years,dem go build 2 new plants 4 inside Georgia by US electricity company. Presido Obama talk say d plant dem go dey safe and clean and say dem need am well well to take do light mata 4 dem country. |

















