| INEC people don say na,Peter Obi na him win Anambra state election. |
|
|
|
|
INEC people don say na All Progressive Grand Alliance person,Peter Obi na him win Anambra state election. Senate fit pass anoda close mata 4 we persido Umaru Yar’Adua tomorrow. Ethiopia dem don see dem Black Box 4 Lebanon. US presido Barrack Obama go talk talk 4 healthcare mata. Senate people fit pass anoda talk talk on top say make persido Umaru Yar’Adua for to take gree do wetin section 145 of d 1999 law book,for inside tomorrow. Tori wey we hear,b say dis one happen as per say persido yar’adua nor carry power give him vice persido Goodluck Jonathan after him don use reach 77days 4 on top him waka go saudi arabia 4 him bodi mata. Dem even don tell,persido wife Turai make she beg him husband make him 4 do wetin we law book say Governor Peter Obi of APGA don win governor election 4 Anambra 4 where INEC person Josiah Uwazuruonye dey dey talk 4 Awka,him say governor obi score 97,843 votes to take win. Mr Uwazuruonye say AC peson, Chris Ngige carry second wit 60,240votes,while PDP person,Chukwuma Soludo carry 3rd wit 59,355votes and Labour Party person,Andy Uba carry 4th wit 20 ,186votes. Also,APGA National Chairman,Victor Umeh say governor obi win becos of work wey him don don down 4 Anambra state. Him come also yarn join say governor obi win nah correct one 4 democracy and say nor b Anambra alone get am,Chief Umeh greet d oda candidate dem say notin mega say nah dem all go join hand do d work. Although,AC candidate chris ngige no gree 4 d result of the election 4 where him dey dey yarn wit talk people 4 Akwa,Dr Ngige yarn say wuru wuru dey inside am him say nah 1.8million voters na him register 4 inside d state but him say na less than 10% of d voters na him see dem name on top list wey fit vote. Still on top dis talk,vice presido Goodluck Jonathan don greet governor Obi 4 him win on top d election.Dr Jonathan also say him belly sweet well well as d election go siriri welele say dis one mean say Nigerian people dey yidigba 4 democracy to take work. Vice persido come join greet INEC people,Nigeria police wit other security people dem on top as dem take work wey gbege na dey inside d election. Lebanese search people don see the black box Boeing 737 Ethopia plane wey bin kaput 4 january 25 for mediterrean side. One army person say dem don carry d black box go one naval base 4 Beirut wey dem go still give investigate people. Dem still dey find the voice recorder for the plane head wit 75 people body. |
















